Nor be sumall arguement happen
for my familee. Wetin cos d wahala? My Mama wake up one morning come tuk sey
she wan dey sell fry fish, yam and potato for front of her store.
Mummy U sey wetin? E belike sey
na robot kontrol her four children wey dey arand her wen she make d statement,
bcox dem all turn their neck dsame tym and korus d “Mummy you say wetin?”
For wetin? Mummy why U go tuk
sey U wan fry Akara? I nor won fry akara, na Yam, Fish and Potato i wan fry, d
kind won wey ur Papa broda wife dey fry and sell b4 Exco supa-store. Em’
whatever, we nor gree. Wich kain moni u dey find?
But why una nor want me to fry?
my Mama kwayetly asked. Mummy we nor gree abeg, wich kain tuk be dat.
None of my Mama children
support her for dis venture and nobody gree tuk why? My Mama jux ignore us and
kwayetly dey karri on wit her plan to augment her source of income wit frying
of yam, potato and fish.
After a while, one early
morning, my yunga sista call me, for phone, “broda Mummy won start d frying
business na oo, she don go carri igaga wey welda make 4 her”. “Okay my dear, i
don hear yhu, i dey com tuk to her.
Only mi cum sidon & tink
abat d whole mata, bet why i nor wan make my Mama fry fish and yam? Why my Mama
go fry akara for dis road, Wen dem know
her as Chief wife, only her get four
graduates, “Wetin she want make pipo
tuk? Sey suffer dey fire our family now? Abi she wan turn our family to
pipo wey area go dey laff and pity?
As i dey tink d mata, i realize
sey i nor get ani beta reason not to support my Mama oda dan d following peti
reasons.
1. Chief Wife
Inside evribodi head, we dey
more special dan d oda persin, and we all don put awasef for wan kain place wey
nobody reach.
How Chief wife go dey fry fish
and yam for road, which kain chief bi dat? Status problem dey very visible
for awa-countiree, na d reason some of us nor gree do some kain work for Warri,
bet wen we travel abroad or outside the city, we go dey do d work wey worse
passam dem, Na d illusion of status naim make some girls go tell their age
mate, U nor know ur klass? Me and U nor dey dsame katigori. Dis unnecessary
self imposed klass system don push pipo to dey do anyhow tins wey dem go regret
for d near future, bcox some girls, d only tin wey dem get na their beauty, no
brain, no handwork, respect or karactar, jux beauty. Dat na why she fit slip
wit her Papa age mate, get up to Mugu 16 as boifriend, jump frum klub to klub, just
to kip up wit an unnecessary status wey nor get reward. D boiz nor commot for
dis sad tin, Yahoo, Yahoo plus, agbero, football betting or bcom homila, naim
boiz dey tink. Nobody wan do the ordinary simple tins wey go bring moni. As a
girl u nor go school, u nor get handiwork, but u dey dress fine, na tief or ashawo
you dey turn urself into. The boiz own be say, even d once wey don graduate nor
go gree do some kain Job, bcox their level pass dat one, but their level nor
pass to beg.
2.
Only her get four graduates.
Only her get four graduates and
some don dey work dey send her moni, wetin she wan take moni do?
This mindset jabarata for awee
countiree, an unhealthy sense of entitlement mentality. Bcox sey my Mama get
graduate children wey dey give her moni, make she nor get her own? Na so a
whole lot of us be, we dey plan awasef or put hope for anoda man resources. You
go see matured man still dey hin Mama and Papa house, dey chop, dey fat even
dey give girl belle and born inside hin Mama house, some dey wait d day wey
their parents go die to take over or bcom, Landlord, if God wan punish those
kain persin, their parents go live 180yrs.
My Mama wants her own moni and
more, she nor wan put hope for only her children, if d children nor dey nkor,
so she nor go horzo? Since i be sumall pikin, my Mama na horzola and dat tin
still dey her blood. Awa-city for don go far if we get d kain entrepreneurial
spirit wey many of awa parents get.
3. Wetin Pipo Go
Tuk?
Mani times for dis awa obodo,
we too dey consign awasef wit wetin pipo go tuk. Pipo go always be Pipo and na
tru tuk u go no say persin dey exist.
Weda u do gud or bad, Pipo go
tuk, so d best be say, just dey do ur sumall biznex jejely and ignore wetin
pipo go tuk. If U kontinew dey tink abat Pipo, u nor go achieve anitin atall.
Some of us dey area wey some
kain local biznex nor dey, bet we nor wan gree drop awa ova size pride and
start d biznex bcox of wetin Pipo go tuk. If nobody dey sell indomie or suya for
nyt, for ur area why U nor fit start am? Dem tuk sey na only hawusa Pipo dey do
dat kain biznex? or roast plantain for ur area, or fry akara, beans and akamu,
see all dis kain biznex wey pipo dey luk troway face, get beta moni. Look arand
ur area and tink of wetin pipo nid for dat area, no mata d kain biznex startam.
New Warri nor bi for prideful Pipo or yanga and shakara Pipo, New Warri na for
both d yung and d old Pipo wey readi to roll up their sleeve and do d hard
work.
Pipo go always, tuk, allow dem to
tuk and kall U names, bet jux maintain ur local and legal biznex dey go, nor
worry, wen dem go come buy kredit, nor sell for dem.
Make i end for here, bet b4 i
go, make i finish with my Mama torii, anyways, she come start her biznex, My
two yunga ones wey disagree, nor get choice bet to join her for d biznex wey
dem see crowd cum gada arand my Mama to buy her fried fish, yam and potato.
Thank you for the time spent in
reading in pidgin, if you don’t mind please leave a comment, so we know what
you think and how we can achieve our #newwarri.
0 Comment to "Why My Mama go Fry Potato, Yam and Fish for Road?"
Post a comment